Where Israel and Palestine dey for map?

Wia dis foto come from, Getty Images
To understand where Israel and Palestine dey rest head for dat Middle East wey dem dey, e dey important to chook eye put why di maps dey arranged di way dem dey.
War bin burst wen Israel declare dia independence afta di British mandate end for 1948 and na dat war cause di division of di territory of Palestine to Israel, Jordan and Egypt.
Hundreds of thousands of Palestinians run or dem bin dey forced to comot from dia native lands during di war wey dem call "Nakba" or "Catastrophe".
Di demand make dis refugees and dia pikin dem to fit return to dia former homes remain one of di biggest ogbonge debated aspect of di kasala with Israel.
So wia Palestine come dey for map?

Di Palestinian National Movement, PNA gradually rearrange demselves for West Bank and Gaza, wey Jordan and Egypt bin dey run respectively, and also for refugee camps around neighbouring Arab states.
Di Palestine Liberation Organisation (PLO) come out as di leading umbrella group shortly before di Six -Day war of 1967, during which Israel bin capture di West Bank, Gaza and East Jerusalem.
For 1993, afta di PLO under Yasser Arafat gradually win di international recognition as di representative of di Palestinian pipo, e result to di Oslo Accords with Israel.
Dis accords na im form di Palestinian National Authority (PNA - wey also dey referred to as Palestinian Authority, PA) as di interim join bodi to run parts of Gaza and di West Bank (But not East Jerusalem) pending we dem fit reach agreed solution to di conflict.
Di Palestinian pipo dey divided between historic Palestine and diaspora wey dey mostly for neighbouring Arab kontris.
Efforts to start Palestinian state for di West Bank of di River Jordan and for Gaza never make head sake of consistent kasala with Israel.
Palestinians wey dey di West Bank and eastern Jerusalem don dey live under Israeli occupation since 1967. While di settlements Israel build for di West Bank be home to 500,000 pipo but e dey seen as illegal under international law although Israel no agree.
Kasala also dey ground ova di status of diaspora Palestinians and weda Palestinians refugees suppose dey allowed to retur to lands wey dme bin dey displaced from wetin now be Israel.
Palestinians don dey hustle for self determination but don get only small control ova dia affairs.
Di relationship wey dem get with Israeli authorities dey marked with violent conflict.
For 2011, di PNA bin bid for symbolic recognition for di United Nations as di "State of Palestine" mainly to torchlight dia lack of movement in relations with Israel, e no work.
But Unesco - di UN cultural and educational agency bin admit di "State of Palestine" as member.
For November, 2012, di UN General Assembly bin vote to upgrade di status of di Palestinians to "non-member observer state".
Dis move go allow dem to fit put mouth for di General Assembly debates and go improve dia chances to join UN agencies.
Which kontri Gaza dey inside?

Gaza na one of di territories wey di pipo of Palestine dey call home.
Na strip of territory wey dey about 40 km long and 10km wide and dey house ova two million pipo.
Sometin wey pipo dey ask na weda Gaza be di capital of di Palestine.
No be so, as di region dey blocked for both sides by Israel and Egypt, and na dis two kontris dey control di borders wey dem dey take comot di territory.
Infact, Palestinians dey claim Jerusalem as dia capital for wen dem get dia state, but Israel too dey follow drag di region too with limited international recognition for both claims.
Di administrative centre of di Palestinian territories na for Ramallah.

Gaza bin dey occupied by Egypt till di 1967 Middle East war wen Gaza bin dey taken ova by Israel.
For 2005, Israel comot dia troops and 7,000 settlers for di region come restrict movement of goods and pipo for Gaza.
For 2007, Hamas wey dey seen as terrorist organisation, take ova di region afta kasala with di Palestinian Authority wey bin dey regarded as umbrella joinbodi in charge of di Palestinian pipo.
But for October 2022, delegates from 14 different Palestinian factions wey also include Hamas sign reconciliatory agreement for Algiers wia dem agree to run presidential and parliamentary elections from a year of signing.
Wia Israel stop and Palestine start?

Since Israel declare say dem be kontri, ova 75 years ago, di borders neva dey fully settled like dat.
Di land wey dem dey call Israel now dey for wia don be part of di Turkish Ottoman Empire.
Afta di Empire collapse and World War One, di victorious allied powers carry di territory wey dem dey call Palestine and land of Israel by Jews give Britain make dem run and create national home for Jewish pipo without destroying di civil and religious rights of non Jewish pipo for di area.
For 14 May 1948, Jewish leader announce di state of Israel with no borders.
Gaza and di West Bank wia Palestinians dey stay now bin dey created afta di war wey start di next day afta di declaration, as Egypt bin occupy di Gaza strip and Jordan occupy di West Bank.
For di Six Day War of 1967, Israel take control of those regions plus including East Jerusalem.
Di final arrangement of Israel and Palestine territories suppose dey decided for negotiations between di two of dem, but off and on tok-tok and kasala no dey let plans move forward.